Pages

Sunday 29 September 2013

Saurez na yanch


undefined
Lius Suarez announse hinsef well well as de Uruguay guyman score two gols for hin fes Premier League match since hin suspenshun for de mago-mago wey hapin between am and Chelsea defenda Branislav Ivanovic kpai.
De swagga wey hin carri come back come score de two goals as Liverpool waka enta Sunderland waya dem 3-1 go jolly coachi Brendan Rodgers belle.
Sunderland start de match like say dem go kill Liverpool and na gear four things dem dey bifor Liverpool sef come shock de score gol as game dey shele.
Daniel Sturridge manage chuk head for cross wey enta Sunderland eighteen, de ball sef hit am for hand come enta net for de 28th minute, but refuree no see am come gif de gol.
As Sunderland come comot for de secon haf to find equaliser, na so Luis Suarez come do dem shege waya de secon gol for Liverpool for de as Daniel Sturridge arrange am pass wey hin no fit miss to make am 2-kondo for de 36 minute, and na so de fes haf finish.
Emmanuel Giaccherini come gif Sunderland small hope, as hin gol for de 52th for de secon haf come make de Black Cats begin dey hol Liverpool to try find de equalizer, but dat one no come be as in the 89th minute ,Daniel Sturridge come cook beta soup serve Luis Suarez ,and de Uruguya Oga no waste time to push Liverpool see road for 3-1.
For de oda match wey dem play on Sunday, Norwich travel enta Britannia Stadium waya Stoke City 1-kondo wit gol wey Jonathan Howson score to gif de canaries ( na Norwich dem nikname be dat) onli dia numba two win dis seasin.
Plenti Stoke fans bin dey jolly say dia new coachi bin don bring beta style for dia team, as dem do dey tap beta ball, no be like dat time wey Tony Pulis bin still dey wey na Police ball dem dey play.
But Jonathan Howson score de onli gol for de game for de 34th minute wit beta shot from 25 yards wey Stoke kipa Asmir Begovic no get ansa for.
Gbege still dey for Norwich and Stoke City sef becos dem dey down for table and na onli three points carri dem comot from relegashun wahala for now.

No comments:

Post a Comment